|

Tins to know about di plan to legalize prostitution for South Africa – BBC News Pidgin

Editor's note: this is printed exactly as it was in the original article here.

Sex workers don dey wan make goment decriminalise prostitution
Wia dis foto come from, Getty Images

South Africa say dem go decriminalise sex work through one Law wey di Minister of justice dey push.

Di cabinet approve di Criminal Law (Sexual Offences and Related Matters) Amendment Bill late last month.

“We hope say di decriminalisation go reduce human rights violations against sex workers,” Justice Minister Ronald Lamola tok.

AFP agency quote sex worker rights' group SWEAT as saying: “Wit sex workers no longer label as criminals, dem fit now work much better wit di police to tackle violence”.

Why goment wan put di Law

Di main reason for di Law na to tackle high level of crime against women for di kontri.

Advocacy groups say dem get over 150,000 sex workers for South Africa.

Recently, authorities retrieve half a dozen deadi body wey many pipo believe say na sex workers wey miss for one building for Johannesburg in October.

Police Minister Bheki Cele say dem don record increase in murder cases of women year-on-year between July and September wit di killing of almost 1,000 women.

Cases of rape also go up  by 11 percent, wit 10,000 cases during di period, Cele add.

Wetin di Law go dey about

South Africa post-apartheid constitution dey among di softest laws in di world.

E allow progressive laws on abortion and same-sex marriage, but e no too address issue of sex work.

Goment don make di bill public so dat members of di public go fit comment on top am.

  • Sex work no go be crime again
  • Goment neva decide weda to regulate di business or not
  • To drastically reduce violence against sex workers
  • E go ban pkin dem from involving in di selling of sex
  • End human trafficking for sexual purpose
  • To ensure say South Africa comply wit International Instruments
  • To delete all criminal records of pipo wey bin involve for sex work
  • Di bill go decide di location wia sex work fit dey happun

Some kontris wia prostitution dey legal

Prostitution na crime for most kontris of di world.

However, e get some kontris wey legalize am but wit strict regulations.

Di Laws na to make am be say pipo no exploit doz wey dey into do business and also to protect sexual workers.

  • Finland
  • Costa Rica
  • New Zealand
  • Austria
  • Bangladesh
  • Denmark
  • Netherlands
  • Canada
  • Germany
  • Greece
  • Colombia
  • Turkey
  • Some states for USA
  • Some states for Australia
 

This “Eyes on Trafficking” story is reprinted from its original location.

ABOUT

PBJ Learning is a leading provider of online human trafficking training, focusing on and prevention education. Their interactive Human Trafficking Essentials is used worldwide to educate professionals and individuals how to recognize human trafficking and how to respond to potential victims. Learn on any web browser (even your mobile phone) at any time.

More stories like this can be found in your PBJ Learning Knowledge Vault.

 

EYES ON TRAFFICKING

This “Eyes on Trafficking” story is reprinted from its original online location.

ABOUT PBJ LEARNING

PBJ Learning is a leading provider of online human trafficking training, focusing on awareness and prevention education. Their interactive Human Trafficking Essentials online course is used worldwide to educate professionals and individuals how to recognize human trafficking and how to respond to potential victims. Learn on any web browser (even your mobile phone) at any time.

More stories like this can be found in your PBJ Learning Knowledge Vault.